By: Esther Ayoola
Di ogbonge senior gunman wey dem accuse say go scatta U.S Presido Donald Trump gala dinner for Washington D.C. USA on Saturday night, say like dis now go make first appearance for court today.
According to U.S officials, say di suspect allegedly bin wan kpai Trump and other top officials during di press dinner before.
Trump himself post video and pictures of how security agents rush am comot from ballroom, while surveillance video show gunman wey dey try pass checkpoint before di gunfire burst.
Authorities say afta small exchange of bullets, dem arrest di suspect for di scene and carry am go detention, as investigation sti dey go on to know di full reason behind di attack.