By: Esther Ayoola
Oyo state govo Seyi Makinde and di 2023 labour party presidential candidate don run anoda closed door meeting.
Say di Oyo state Govo host Peter Obi with im delegation for im Office for Agodi, Ibadan on Tuesday.
Speaking with tori pipo afta di meeting, Obi say di visit na part of ongoing tuks and consultation about coalition wey dem dey plan run for 2027 general elections.
Dis meeting sef dey happen few days afta coalition summit for Ibadan.