Vice Presdio, Kashim Shettima don tell leaders and people wey wan contest under All Progressives Congress make dem ensureĀ peace and work together as dem dey prepare for primaries and 2027 election.
For one statement wey dem release for Abuja on Wednesday, e warn say if party members nor dey unite, e fit affect dem chances to win.
Shettima beg dem not toĀ provoke each other and always show maturity for how dem dey handle party matters.
E still remind dem say APC na family, no be place for fight or quarrel.