Senate Presido, Godswill Akpabio don scatt im mouth untop matas, say National Assembly dey aware of di hardship wey Nigerian workers dey face.
According to di message wey di senate presido send to mark 2026 Workers’ Day, say di national assemble go continue to work on laws wey go improve workers’ welfare.
Di naija number three man, Akpabio assure nigerians say di 10th National Assembly go try dia best to make life beta for workers and improve workplace conditions.