Manchester United legend manager, Sir Alex Ferguson, don land hospital after health matter catch am for Old Trafford.
Di incident happen just before Sunday Premier League showdown between Red Devils and Liverpool.
According to BBC, no be life-and-death emergency, na to play safe dem rush am go hospital.
Even with that one, Sir Alex still comot di stadium inside ambulance.
People for United camp dey confident say di Ferguson go bounce back quick and return house soon.
As di drama dey happen off pitch, Michael Carrick boys dey battle for at least one point, wey fit secure dem Champions League spot for next season.
Written by: Rilwan Agbomeji
English Premier League MANCHESTER UNITED Michael Carrick sir alex ferguson