Nigeria Democratic Congress (NDC) don reserve dia 2027 presidential ticket for Southern Nigeria, and many people dey talk say dis move fit boost former Anambra State Governor, Peter Obi chance well-well.
Dem make di announcement on Saturday during dia national convention wey dey happen for Abuja.
Di party still confirm am for dia official X handle, as dem post say, “NDC presidential ticket don go South!”
Top party big men dey for di convention, including Peter Obi and former Kano State Govo, Rabiu Kwankwaso.
Written by: Rilwan Agbomeji
ELECTION ndc PETER OBI