OBODO NAIJA

11 Pipo Kpai as Motor Fall From Eruku Bridge for Ogun Expressway

todayMay 11, 2026 6 3

Background
share close

By : Joalyemi Olajide

Say nor be small badness up along Lagos-Abeokuta Expressway for Ogun State, at least 11 pipo kpai after one Toyota vehicle fall from Eruku Bridge

According to Ogun State FRSC tuk, tuk person, Afolabi Odunsi, di gold Toyota throw bakky from di bridge, though officials never fully Konfam wetin cause the accident.
He explain say all 11 occupants inside the motor, 10 adult men and one woman, kpai instantly because of di impact of the crash.
FRSC rescue team from Itori Unit Command sha rush go the scene after the incident to recover di bodies and don begin investigation into how the fatal askident take hapun.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds