Lagos

Lagos Council Beg Residents To Protect Public Property

todayMay 11, 2026 2

Background
share close

By: Esther Ayoola

Oga Works and Infrastructure Supervisor for Eredo Epe Local Council Development Area, Bayo Opetuga, don call on residents make dem protect public infrastructure for dia communities.

Opetuga tuk dis one on Monday during inspection of projects wey di council execute for Eredo Epe area of Lagos State.

E explain dat, when pipo protect gornment facilities, e dey always hellep preserve di gorment project stay longer.

Di council official sti warn residents to stop vandalism and careless attitude toward public property because e dey affect di common good of everybody.

Written by: News Editor 2

Rate it

Similar posts

Lagos

Lagos Gorment Close Eko Bridge For Repairs, Give Traffic Alert

By: Esther Ayoola Di Lagos State Gornment don announce emergency closure of di outbound lane of Eko Bridge for Lagos Island. According to Commissioner for Transportation, Oluwaseun Osiyemi, through statement wey dem wrap like moimoi, say di closure go start on Tuesday, May 12, 2026, for safety checks and repair […]

todayMay 11, 2026 3


WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds