By: Esther Ayoola
Say like dis, na serious Leadership gbege dey inside Nigerian Medical Association, Lagos chapter, dat different groups dey claim leadership position.
Dis one sef start on Monday few days afta national leadership konfam, Dr. Babajide Saheed as chairmo of di Lagos branch.
One faction for di Lagos chapter later announce say dem don remove Saheed from office over alleged violation of di association constitution.
According to di group, dem make dis decision during Emergency General Meeting wey hold on April 18 for Lagos University Teaching Hospital where members discuss every about di mata.