OBODO NAIJA

JAC, FG Start Talks After SSANU, NASU Suspend dia Strike

todayMay 12, 2026 3

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

Joint Action Committee wey include Senior Staff Association of Nigerian Universities and Non-Academic Staff Union of Educational and Associated Institutions wey bin start indefinite strike on April 30, don begin tuk with  Federal Gornment  over dia  renegotiation of 2009 agreement, allowance and welfare issues.

On May 11, union leaders announce say dem don suspend di strike after dem receive assurance from gornment renegotiation committee.

SSANU National President Mohammed Ibrahim wey also be JAC chair  naim konfamate dis update for Abuja.

Ibrahim still explain say di tuks dey happen for National Universities Commission headquarters for Abuja, as dem dey try settle all di pending demands.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds