By : Jolayemi Olajide
E belike beta dey come oh as Wi oga Presido Bola Tinubu and CAF Presido, Patrice Motsepe do small two aside for Nairobi Kenya, just after di Africa Forward Summit meeting on Tuesday.
For di meeting, Nigeria Football Federation president Ibrahim Gusau, former NFF boss Amaju Pinnick and CAF acting secretary-general Samson Adamu also join Motsepe and Tinubu.
According to Gusau, say dem discuss how dem wan take build stadiums and how to return Nigeria back to di glory days  of hosting big tournaments.