By : Olajide Jolayemi
Wi oga Presido, Bola Tinubu don land Kigali, Rwanda, to attend di Africa CEO Forum 2026.
Say na Rwanda Presido, Paul Kagame welcome am for Urugwiro Presidential Village after im arrive through Kigali International Airport.
Video wey dem post show Tinubu dey do korkor come down from Nigerian Air Force plane enter red carpet, while senior Rwanda officials receive am.
Di President still inspect guard of honour and greet Nigerian plus Rwandan dignitaries before im convoy move comot airport.