OBODO NAIJA

Former Ondo Governor Mimiko Dump PDP, Join APC to Support Tinubu

todayMay 14, 2026 3

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

Former Ondo State govo, Olusegun Mimiko, don formally join All Progressives Congress after e resign from Peoples Democratic Party last month.

Mimiko join di ruling party on Thursday for APC secretariat in Ward 7, Ondo West Local Government Area, where e explain say im decision na to support President Bola Ahmed Tinubu and help move Nigeria forward.

Di former govo explain say Tinubu-led gornment don already do many good things, even though more work still remain to push di country toward peace, progress and genuine development.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds