By: Esther Ayoola
Teachers for Ogbomoso, Oyo State on Monday lock classrooms oh, and do peaceful protest sake of say jaguda boys carry dia teachers and students.
Di protesters carry placards dey beg gornment at all levels, make dem work harder to rescue dia pipo wey kidnappers kidnnap.
Di kidnapping for Oriire Local Government don cause serious fear and concern among teachers, parents and residents for di state.
To tell you how di tori worwor reach, baba Govo, Seyi Makinde even konfam say one abducted teacher kpai, but im sha promise say gornment nor go stop until dem rescue di remaining victims.