Sport Yarns

Arsenal Near Premier League Glory As Burnley Win Put Dem 5 Points Clear

todayMay 19, 2026 3

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

One game to go as Arsenal plan  to end  dia 22-year wait to win Premier League,  beating Burnley 1-0 on Monday and move five points clear .

Kai Havertz naim score di only goal with header, but e lucky escape red card wey fit change di title race.

Arsenal fit even win di league as early as Tuesday if Manchester City fail to win dia match against Bournemouth.

Even if City still win, Arsenal go still take di trophy if dem beat Crystal Palace on Sunday.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds