OBODO NAIJA

FAAN Tighten Airport Checks Sake Of Ebola

todayMay 20, 2026 5

Background
share close

By: Jolayemi Olajide

News report: Federal airport authority of Nigeria, FAAN don activate extra safety doings for all international airports for Nigeria to stop Ebola Virus Disease wey don dey scatta body for some parts of Central Africa.

For statement wey Director of Public Affairs and Consumer Protection, Henry Agbebire release, im talk say officials don start to screen passengers for Ebola symptoms across di airports.

Di agency say dem dey work with Port Health Services and NCDC to increase monitoring and surveillance, especially for passengers wey dey come from high-risk areas.

Di move hapun to stop possible spread of di disease into Nigeria through air travel and strengthen health security for passengers and airport workers.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds