By : Jolayemi Olajide
Senator wey dey represent Ogun West, Solomon Adeola, don win di APC ticket to contest for di 2027 governorship election for Ogun State.
Oga Chairmo of di primary election committee, Wale Ohu, naim announce di result for Abeokuta afta Adeola pack 304,055 votes, while his opponent, Abayomi Hunye, get zero vote.
Out of di 305,287 voters wey come out to vote inside di 20 local government areas, almost everybody choose Senator Adeola.