By : Jolayemi Olajide
Wi oga Presido, Bola Tinubu don hail di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) afta dem burst one big Nigerian-Mexican drug cartel and scata dia multi-million-dollar business.
Di President salute dem inside one statement wey im number one tatafo, Bayo Onanuga, release on Thursday for Abuja.
NDLEA Oga, retired Brig.-Gen. Buba Marwa, bin announce on Wednesday how dem take catch di bad guys afta weeks of coded intelligence work with international security partners.
Dis heavy operation lead to di arrest of some beta Juju (foreigners), local drug lords, and dia workers, plus dem seize chemical and heavy drugs wey worth pass 360 million dollars.