Sport Yarns

Ebola Wahala Force DR Congo Team Cancel Kinshasa World Cup Camp

todayMay 22, 2026 6

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

DR Congo national football team don cancel dia three-day World Cup training camp and farewell event for Kinshasa because of di Ebola outbreak wey dey worry eastern part of di country.

World Health Organization don declare di Ebola outbreak for Congo and Uganda as serious international health emergency afta over 600 suspected cases and at least 139 suspected deaths.

Team tuk, tuk, Jerry Kalemo, sha clear mata say na only di Kinshasa training dem cancel, but dia friendly matches against Denmark for Belgium and Chile for Spain go sti hapun.

Most of di Congo players and dia French coach, Sébastien Desabre, dey based outside di country, especially for France.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds