By : Jolayemi Olajide
US Presido, Donald Trump don drop micro soft word again oh, say confusion sti gadima, dat Iran nor gree peace deal oh.
Na im workers for White House naim dey porpori dis mata on sunday, say, as dem dey look am with corner eye, say di final agreement fit take some days before e go set.
According to wetin one Al Jazeera reporter for Washington, DC tuk, nothing don clear on top wetin go hapun next because of de long arguments wey still dey ground.
As e dey stand now, nobody fit say for sure, when de whole mata go end, as de two countries still dey drag some important points for de peace tuk.