Argentina coachie, Lionel Scaloni don release im 26 players wey im wan carry go di 2026 world cup say na Lionel Messi go lead dem.
Di 38-year-old football king na im top di list, but one big surprise na say Real Madrid star boy Franco Mastantuono no dey among di players wey dey go di tournament.
Dis major competition go make am di sixth time wey Messi dey play for World Cup.