By: Esther Ayoola
Super Falcons players don begin baf enter camp for Ikenne, Ogun State, as dem dey prepare for two friendly matches against Senegal before WAFCON.
Dis one dey happen after Naija Football Federation (NFF) release di names of 23 players wey di head coach, Justine Madugu, select for di big matches.
Top stars like captain Rasheedat Ajibade, goalkeeper Chiamaka Nnadozie, and veteran striker Asisat Oshoala all dey inside di squad.
Midfielder Ngozi Okobi-Okeoghene also make di list afta she return text-book style from three years break, join with other sharp forwards like Francisca Ordega and Gift Monday.