Sport Yarns

Messi collobi anoda big award, di ‘Princess of Asturias’ award for sports

todayJune 3, 2026 5

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

Argentinian football legend, Lionel Messi, don win oda senior man award again oh, di Princess of 2026 Asturias Award for Sports based on im tear-rubber performance for football.

The foundation wey dey in charge of the award give the updates on Wednesday say dem choose Messi because of im worldwide impact.

The 38-year-old superstar start im career from Newell’s Old Boys youth team before im travel go Spain join Barcelona La Masia academy when im dey just 13 years old.

People dey hail this award as one big honor to  cap for the fine work  wey di Rosario-born maestro don do.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds