south west

South-West Gofnors Join Bodi To Fight Crime As Court Jail Owo Church Attackers

todayJune 4, 2026 9

Background
share close

Gofnor Lucky Aiyedatiwa of Ondo State don clear matas say all the South-West gofnor dem dey  join bodi work to secure the region.

Di gofnor yarn dis one on Wednesday after one High Court for Abuja jail four pipo wey get hand for di bad attack wey happen for St. Francis Catholic Church inside Owo town back for 2022.

Aiyedatiwa explain say, di  govos even meet for Ibadan inside Oyo State to plan how dem go take use dia local security group wey be Amotekun protect di area.

Dis plan dey come as tension dey high for diSouth-West area after bad pipo go kidnap some teachers and students for Oyo State and do another kidnap for Ekiti State.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds