By: Esther Ayoola
Wahala hapun on Thursday say NPFL side, Rivers United, get road aakident as dem dey travel go Awka for Anambra State for dia President’s Cup match against Nasarawa United.
The club konfam inside one statement say the accident hapun for Obiri-Ikwerre Airport Road outskirt of Port Harcourt, just after di team leave dia camp.
Naso some players and officials get small-small wounds for body, but thank God say nobody kpai and nobody get any serious injury wey fit take life.