By : Jolayemi Olajide
Peter Obi don challenge Federal Government on Tuesday make dem open eye tell Nigerians wetin dem use all di money wey dem borrow do as country gbese dey load near 200 trillion naira.
Di NDC presidential candidate drop dis tuk for em X handle where he complain say Nigeria gbese don jump up with pass 100 trillion naira within just three years.
Obi yarn say di way President Bola Tinubu govt dey pack debt gbese country dey make pipo reason whether dem get plan for the economy or if dem dey transparent at all.
He say things must change now because Nigerians need to know how di govt dey spend money make everybody for clear eye.