Nigeria Democratic Congress

8 Results / Page 1 of 1

Background

OBODO NAIJA

Obi Warn Riggers Say Mehn Don Wise for Di Town

By: Mariam Ajayi Nigeria Democratic Congress,  Presidential Candidate Peter Obi don raise voice dey shout, say  nobody gree  for any kind of vote-stealing or trick come 2027. Obi drop dis heavy bomb on Thursday for inside Port Harcourt town hall meeting. Di former Anambra Gorfnor insist say dis time around, every single vote must enter tally sheet complete without any corner-corner or mago mago-way.

todaySeptember 4, 2026 8

OBODO NAIJA

Peter Obi Blame Naija Professors Say Na Dem Dey Rig Elections

By: Yusuf Abuh Presidential candidate of di Nigeria Democratic Congress for di 2027 election, Peter Obi, once again  don trow lamentation say, Naija judges don badje, dat Naija democratic values na suffer dey dey mood e dey compare to before, so tey university professors now, dey help rig elections. Obi tuk dis one on Tuesday for di 2026 Goodluck Jonathan Foundation Democracy tuk tuk doings for Bauchi. Di former Anambra […]

todayAugust 12, 2026 12

National

Peter Obi Question Borrowing, Say Nigerians Never See Improvement

By: Esther Daniel 2027 presidential candidate of di Nigeria Democratic Congress (NDC), Peter Obi, don question di current administration over increased borrowing despite saying subsidy payment don stop. Obi tok say even though Gornment dey generate more revenue from different sources and no longer dey pay fuel subsidy, di country don still borrow pass when subsidy dey. According to am, ordinary Nigerians never see any visible improvement for dia daily […]

todayJuly 27, 2026 14 2

National

Peter Obi Repeat Promise, Say Four Years Is Enough To Fix Nigeria

By: Esther Daniel 2027 presidential candidate of di Nigeria Democratic Congress (NDC), Peter Obi, don repeat say if Nigerians elect am as Presido, e go serve only one term because four years dey enough to put Nigeria for di right path. Obi tok during one siddon tuk interview say im one-term promise no be campaign strategy, adding say e and im running mate, Rabiu Kwankwaso, agree on di arrangement based […]

todayJuly 27, 2026 17 2

OBODO NAIJA

NDC  Upload Peter Obi Name As Dia Presidential Candidate for 2027

By : Jolayemi Olajide Unto election 2027 waka, say di breeze don blow reach di Nigeria Democratic Congress (NDC),  like dis,  dem  don successfully upload di papers of dia presidential candidate,  Peter Obi, enter di INEC portal. Di National Leader of di party, Sen. Seriake Dickson, break di news for im 'X' handle and explain say everything dey waka uniform with di INEC timetable. Dickson tuk say di name of […]

todayJuly 1, 2026 8

OBODO NAIJA

Obi Lawyers Drag Kenneth Okonkwo, Demand N5bn

Nor be small thin oh, as two best frens don turn enemies, say like dis, di Presidential candidate of Nigeria Democratic Congress, NDC, Peter Obi, don tell im lawyers say make dem drag former actor- wey turn-politician Kenneth Okonkwo to pay N5 billion damage dat im spoil im name for public According to tatafo, Kenneth go tv sit down tuk use yamchop call di former Anambra state govo bad name, […]

todayJune 10, 2026 15

OBODO NAIJA

Peter Obi Dey Ask Govt To Show Wentin Dem Use Almost 200 Trillion Naira Debt Do

By : Jolayemi Olajide Peter Obi don challenge Federal Government on Tuesday make dem open eye tell Nigerians wetin dem use all di money wey dem borrow do as country gbese dey load near 200 trillion naira. Di NDC presidential candidate drop dis tuk for em X handle where he complain say Nigeria gbese don jump up with pass 100 trillion naira within just three years. Obi yarn say di […]

todayJune 9, 2026 13

National

Peter Obi Clear Nigerians Not To Blame Any Tribe For Criminality For Naija

By: Esther Ayoola Naija Democratic congress, presidential candidate, Peter Obi don drop some wisdom word (oro ogbon), say make Nigerians make nor tagget any particular tribe for all di security badness wey dey sup for Naija. For message wey e post for im verified X handle on Monday, Obi tok say as Igbo man, e don face plenty name calling and say many Fulani people dey suffer di same thing […]

todayJune 8, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds