south west

Osun Police gbab 3 Suspected Cultists, jaguda boys, Recover Pistols

todayJune 10, 2026 6

Background
share close

By : Shalom Ovie

Osun State Police Command say dem don arrest three suspected cultists and political thugs during separate operations for di state.

For statement wey Police Public Relations Officer, DSP Abiodun Ojelabi release on behalf of CP Ibrahim Gotan, dem identify di suspects as Adekola Olayinka Abdulazeez, Omolara Ezekiel and Babatunde Azeez.

Police say dem recover dangerous weapons from dem including three English Beretta pistols, cut-to-size gun, live ammunition, cartridges, cutlasses and axes.

di command add say investigation still dey go on as dem dey try link di suspects to other criminal activities for di state.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

Similar posts

south west

City Boy Movement Oga Olufemi Onireti Do Medical Giveaway Oyo Community

By : Jolayemi Olajide Oga Director for City Boy Movement inside Oyo State, Olufemi Onireti, don distribute ogbonge medical equipment and drugs give Esinele community for Oriire Local Government Area on Tuesday. Onireti wire dis beta donation during one solidarity visit to help di pipo afta bad boys go kidnap […]

todayJune 10, 2026 3


WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds