OBODO NAIJA

Obi Lawyers Drag Kenneth Okonkwo, Demand N5bn

todayJune 10, 2026 10

Background
share close

Nor be small thin oh, as two best frens don turn enemies, say like dis, di Presidential candidate of Nigeria Democratic Congress, NDC, Peter Obi, don tell im lawyers say make dem drag former actor- wey turn-politician Kenneth Okonkwo to pay N5 billion damage dat im spoil im name for public

According to tatafo, Kenneth go tv sit down tuk use yamchop call di former Anambra state govo bad name, dat im nor be beta leader, and dat im dey spoil tins for south east pipo.

Dis one dey inside letter wey dem write on June 9, Obi legal team oga,  Senior Advocate of Nigeria, Alex Ejesieme, dey accusate Okonkwo say im tuk bad against  Obi.

Di lawyers say, Okonkwo statements don already spread like egg for miechie and dat e dey affect obi mental health, dat e no believe na fren do am dis tin.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds