By : Shalom Ovie
EFCC Chairmo, Ola Olukoyede, don open secrete tuk why public money dey lost, say na based on di fact politicians dey spend too much for election.
Naim make once dem enter office, dem go begin gather money wey dem spend for election and con take extra.
E tuk dis one on Wednesday for one lecture for University of Ilorin about peaceful and credible 2027 elections.
However Olukoyede come say EFCC go continue to fight vote-buying and other election fraud.