By: Esther Ayoola
Women wing of di Mandate Movement for Oshodi-Isolo Local Government don visit dia coordinator, Alhaji Kehinde Olorunoje, for him Mafoluku house on Thursday to show support for him leadership.
Di women say some people dey try hijack di group leadership through backdoor politics, but dem no go gree because di movement get recognised leaders and constitution.
Dem call on GAC member and apex leader of di group, High Chief Muraina Taiwo, to warn anybody wey dey claim leadership without proper backing.
Di women say dem stand gidigba with di current leadership and go continue to work for peace, unity and APC success for Oshodi-Isolo and Lagos State.