By : Jolayemi Olajide
London court don kpake two jaguda boys, Roman Lavrynovych and Stanislav Carpiuc, find dem guilty, say dem bin dey plan to burn prime minister, Keir Starmer. house and car.
Di two men, wey be 22 and 27 years old, do di attack for May 2025. Dem go target two houses for north London one house wey company wey Starmer use to direct manage, and di second one wey be Starmer old house wia im sister-in-law and her family dey live.
Lawyers explain say di attackers light fire for di front door of di houses, and dat one put di life of everybody wey dey inside for serious danger.