By : Jolayemi Olajide
Di Obidient Movement don come out strong to condem say dem wetin di Federal High Court order INEC to delete five political parties, nor make brain at all.
U sabi, Justice Peter Lifu give di order on Monday, say di parties, ADC, Accord, APP, AA, and Zenith Labour nor go run for di 2027 election dat dem nor follow constitution.
Na one group of former lawmakers file the case, say dem want make INEC remove any party wey no fit win enough votes or seats for election.
But the Obidient Movement, through dia National Coordinator, Yunusa Tanko, say, dis ruling na big wahala to our democracy and e go stop plenty pipo from joining body for politics.