Play, play, truth don dey come out, u remember dat jogolo wey dem take suspend Kogi Senator, Natasha Akpoti for wi senate dat time Senator Adams Oshiomhole wey dey represent Edo North don come out nack tori, say dem forge di signature of at least three senators put for di report for di suspension letter.
Oshiomhole yanyanpu dis mata for tv sitdown tuk on Monday, say ojoro everywia, ahooo.
Di former Edo govo, tuk say plenty lawmakers don call am, low-key, con deny say dem no know about di report and dem no ever sign am.