By : Jolayemi Olajide
Nor be small fire for wi house of representative today, wia minority caucus drop bars say, President Bola Tinubu nor dey try at all, dat insecurity wan finish di giant of Africa.
Dem yarn dis one for National Assembly for Abuja, according to Minority Leader Fred Agbedi, Nigeria don enter one of im worst period since 1999 democracy, say dis one, na demonstration of craze .
Agbedi say gornment just dey focus on 2027 election mata instead of the real suffer, suffer wey Nigerians dey face, as “Nigeria dey bleed and dey confused.”