obodo oyinbo

Iran Say Dia Missile Programme No Dey On Top Table

todayJune 18, 2026 6

Background
share close

Gbege don finally drink water keep cup for inside di middle east as US Presido, Donald Trump and Iran Presido Masoud Pezeshkian sign one peace deal wey dem dey call Memorandum of Understanding, for early mormor on Thursday.

Dis deal go open door for fresh talks on top Iran nuclear programme and possible removal of sanctions wey dey affect Tehran.

But one major issue wey di deal no touch be say, dem no talk anything about Iran missile programme, wey be serious issue for US and Israel.

And Iran don make am clear say dia missile programme no go join any future peace talks with US, even after both countries agree to end dia war.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds