OBODO NAIJA

Senate Clear Road For State Police Across Nigeria

todayJune 25, 2026 7 1 5

Background
share close

By: Yusuf Abuh

Di Senate on Tuesday pass bill wey go amend di 1999 Constitution to allow state police begin operate for all states across Nigeria.

Senate Leader, Sen. Opeyemi Bamidele, present di bill before lawmakers consider and approve am afta more dan two-thirds of senators vote in support.

Di bill create two police systems, Federal Police Service and State Police Services, to replace di current single Nigeria Police Force structure.

One key provision for di bill be say state governors go fit appoint Commissioners of Police for dia states, but di state Houses of Assembly must first konfam di appointments.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds