By : Jolayemi Olajide
Nigeria Government say e go sti bring Nigerians back from South Africa on Tuesday because of fresh attacks on foreigners.
Foreign Affairs Minister Bianca Odumegwu-Ojukwu tell news tatafos on Tuesday, say another flight go leave dis week.
Three groups of Nigerians don already return since the evacuation start last month.
She also advise Nigerians wey still dey South Africa make dem think well whether to stay or come back home.