south africa

11 Results / Page 1 of 2

Background

Politics

Obasanjo Tok Say Nigeria Help End Apartheid for South Africa

By: Kofoworola Olayinka Former Presido Olusegun Obasanjo don say South Africa for struggle to end apartheid without Nigeria strong support during di gbas gbos against white minority rule. Obasanjo tok am while speaking on Naija role in di anti-apartheid struggle, saying Naija oppose di system because dem believe say no Black person suppose dey treated like inferior human being. E say  make Naija join hands with other African leaders to […]

todaySeptember 14, 2026 13

OBODO NAIJA

65 Nigerians Comot South Africa On Top Foreigners Wahala

By: Mariam Ajayi Another 65 Nigerians don return from South Africa as xenophobic attack and protest against foreigners. The returnees, wey include 30 adults, 34 children and one infant, arrive Lagos on Wednesday night through South African Airways. Foreign Affairs Minister, Bianca Odumegwu-Ojukwu, say private individuals fund the repatriation. She appeal to state governments to support the returnees, especially those wey leave their businesses and properties for South Africa.

todayAugust 27, 2026 17

Sports

Ajibade Beg Super Falcons To Prepare Better After WAFCON Defeat

By: Kofoworola Olayinka Super Falcon captain Rasheedat Ajibade say Nigeria must prepare better after losing 2-1 to South Africa for WAFCON. She say di team must stop complacency because women football for Africa don become more competitive. Ajibade say players must reflect, improve and demand more from themselves. Nigeria had earlier lost 1-0 to Cameroon, missing di WAFCON semi-finals for di first time.

todayAugust 14, 2026 24

Sports

Super Falcon Lose World Cup Ticket To South Africa

By: Kofoworola Olayinka Super Falcon don lose 2-1 to South Africa on Thursday for WAFCON play-off in Morocco, ending Nigeria hope of reaching 2027 Women’s World Cup. Nigeria had already miss qualification after dem lose to Cameroon for quarter-final on Sunday. Di defeat also end Falcon record of reaching at least semi-final for every WAFCON. The loss mean Nigeria go miss the Women’s World Cup for di first time since […]

todayAugust 14, 2026 23

obodo oyinbo

South Africa See Shege As Migrants Comot

South Africa dey face serious labour shortage after thousands of foreign workers leave di country because of anti-migrant attacks and tighter immigration enforcement. According to One Zimbabwean farmworker wey porpoly dis mata, Aaron Majatamhe, say plenty fruits and grapes still dey for farms because no enough workers dey to harvest them. Di shortage don affect farms, factories and even homes, as employers now dey struggle to find workers. Reports show […]

todayJuly 29, 2026 22

OBODO NAIJA

FG Send South Africa Message To Stop Attacking On Nigerians Now

By: Yusuf Abuh Wi Federal Government don warn South Africa make dem take serious action to stop di fresh wave of xenophobic attacks wey dey target Nigerians and oda Africans for dia country. Minister of State for Foreign Affairs, Ambassador Sola Enikanolaiye, yarn dis one during meeting with South Africa Minister of International Relations and Cooperation, Ronald Lamola, say na about 98 Nigerians don kpai  since 2022, and criminals suppose […]

todayJuly 28, 2026 25

OBODO NAIJA

FG Wan Bring back more Nigerians Back from South Africa Over Xenophobic Attack 

By : Jolayemi Olajide Nigeria Government say e go sti bring Nigerians back from South Africa on Tuesday because of fresh attacks on foreigners. Foreign Affairs Minister Bianca Odumegwu-Ojukwu tell news tatafos on Tuesday, say another flight go leave dis week. Three groups of Nigerians don already return since the evacuation start last month. She also advise Nigerians wey still dey South Africa make dem think well whether to stay […]

todayJuly 7, 2026 16

OBODO NAIJA

 FG Tell Nigerians For South Africa Not To Fear, Say Dem Dey With Dem

Federal Gornment don assure Nigerians wey still dey South Africa say dem safe, even as fresh xenophobic protest don raise fear across di country. Another 269 Nigerians wey government evacuate don land Lagos from Johannesburg, while reports say gunmen kill one Nigerian businessman wey dem sabi as Big Joe for Mpumalanga. Thousands of South Africans march for different cities, dey demand make undocumented foreigners comot, as police deploy security to […]

todayJuly 1, 2026 16

Sports

Switzerland Win Canada, South Africa Shock Korea

By: Yusuf Abuh Switzerland don finish top of Group B afta dem beat Canada 2-1 for dia last group match. Ruben Vargas and Johan Manzambi score for Switzerland before Promise David pull one back for Canada, but di Swiss side hold on to collect di win. For Group A, South Africa shock South Korea 1-0 as Thapelo Maseko score di only goal of di match as dem reach di knockout […]

todayJune 25, 2026 24

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds