By : Jolayemi Olajide
LAUTECH Teaching Hospital Ogbomoso don discharge 31 pupils wey dem rescue after kidnappers abduct dem from schools for Oriire Local Government Area of Oyo State.
Di hospital Chief Medical Director, Olawale Olakulehin, konfam say di children don pass medical checks and dem don reunite with dia families.
Im  explain say na 39 rescued pupils dem admit for di hospital after dia  release, but eight of dem still dey under medical care and observation.
Di  hospital assure parents say doctors go continue to monitor di children’s physical and mental health until all of dem fully recover.