Lagos

Sanwo-Olu Promise Better Drainage System for Lekki Residents

todayJuly 16, 2026 5

Background
share close

Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don promise say im gornment go increase drainage work to make water flow better and reduce flooding for different parts of Lagos.

Baba Govo tuk dis one on Wednesday after e inspect communities wey flood dey disturb for Chevron Drive, Ibeju-Lekki, and other areas dem.

Di govo promise say government go increase dredging, excavation and drainage expansion work for di affected areas so water go flow wella.

He also blame residents say na dem dey add to dis palava as dem dey encroach land, build illegal structures and block gutter with dorti, say all dis kind things dey block di flow of water.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds