Oga Bola Tinubu don gree make Nigerian Army open new battalion for Omu Aran, Irepodun Local Government Area of Kwara State to help fight bandits, kidnappers, terrorists and oda criminals.
Kwara State Govnor, AbdulRahman AbdulRazaq, make di announcement on Tuesday through im Deputy Chief Press Secretary, Mashood Agboola.
According to di govnor, di new battalion go bring more soldiers and military equipment come di area to improve security, especially for communities wey kidnappers and bandits don dey disturb.
Im add say di approval show say di Federal Government dey serious about tackling insecurity and protecting lives and property for Kwara State.