Lagos

NSCDC Burst Fake School, Rescue 106 Youths For Badagry

todayJuly 21, 2026 10

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

NSCDC don burst one alleged fake university wey dey run from one three-bedroom flat for Ilado, Badagry, and rescue 106 youths wey dem allegedly use fake foreign school admission package carry enter trap.

Di operation happen early Monday after security people monitor di place for days, as dem arrest di man wey dem say na im own di fake school.

According to NSCDC, di suspects dey lure young people from different parts of Nigeria and some West African countries with promise say dem go enter foreign university.

Badagry NSCDC Area Commander, CSP Gbenga Ekunola, say better intelligence na im lead to di raid, while di rescued youths, most of dem between 19 and 24 years, still dey with security officers as investigation dey continue.

 

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds