By: Yusuf Abuh
Wi Presido Bola Tinubu don tia shirt oh, say some state govos just dey waste gorment money.
Dat dis gofnors just dey build fly over up and down even when di place nor get traffic
Baba Seyi tuk tok dis one when im receive Oyo State traditional rulers for Aso Rock
Baba say im nor understand wetin dey hapun, dat now state gorment dey pocket beta kpogiri and dem suppose activate, instead of building flyover one, flyover two, flyover three.