OBODO NAIJA

NARD Give Federal Government August 10 Deadline, Threaten Nationwide Strike

todayJuly 31, 2026 8

Background
share close

By: Yusuf Abuh

Nigerian Association of Resident Doctors (NARD) don give Federal Gornment till 8:00 a.m. on Monday, August 10, 2026, to fulfil di agreement wey dem sign before, or dem go begin total and indefinite strike for public hospitals across di country.

Di doctors tok dis one after dia National Executive Council (NEC) meeting wey hold for Gombe State, say plenty promises wey gornment make never see implementation.

Dem complain say doctors still dey face attack and harassment for work, salary and promotion arrears never complete, working condition bad, and resident doctors for LUTH dey suffer alleged intimidation and poor treatment.

NARD say if gornment no act before di deadline, doctors for public health facilities nationwide go down tools until dia demands dey met.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds