By: Esther Daniel
ADC big man Kenneth Okonkwo don blast oga presido Bola Tinubu over him defence of INEC, say di electoral body never prove to Nigerians say dem dey fair and neutral.
Okonkwo react after Tinubu talk am on Tuesday during meeting with Catholic Bishops for State House, Abuja, where di presido defend di commission.
Tinubu insist say INEC still dey independent and say people wey dey question dia credibility na people wey “dey fear dia own shadow.”
But Okonkwo maintain say na INEC actions, no be words, go convince Nigerians say di commission fit conduct free and fair elections.