By: Esther Daniel
Federal Gornment don clear Nigerians say no plan dey to increase electricity tariff, as Power Minister Joseph Tegbe tok say Tinubu gornment wan focus on better light, no be higher bill.
Tegbe yarn dis on Friday for Abuja, say gornment main target na make more Nigerians get steady electricity, everybody get meter, and people pay only for di light wey dem use.
Di Minister still reveal say Nigeria don dey generate steady 5,000 megawatts of electricity for di past two weeks, show say di power sector dey improve small-small.
According to am, gornment no wan put extra load for Nigerians now, but dey channel dia energy into making electricity supply better before any oda discussion.