Former Nigeria Dream Team coach Bonfrère Jo don break table oh say 30 years after e lead Nigeria win Africa first-ever Olympic football gold for Atlanta 1996 Olympic Games for Georgia, USA, Nigerian gornment never recognise or reward am for di historic achievement.
Di 80-year-old Dutch coach porpoly dis mata for interview give nes tatfos on Monday, say while many players collect national honours, cash and houses, e nor receive anything, and even di Olympic gold medal wey dem give am disappear after im give am to one team official hold.
Bonfrère explain say e don reach out to relevant authorities several times to seek recognition, but nothing comeout.
Di former coach say e still dey hopeful say Nigeria gornment or di appropriate authorities go one day honour am because na im guide stars like Kanu, Okocha, Amokachi and Amuneke to Nigeria’s greatest Olympic football success.