By: Esther Daniel
Former Osun Gofnor Olagunsoye Oyinlola led PDP faction don endorse APC gofnorship candidate Bola Oyebamiji for Saturday’s election, during meeting for Osogbo on Sunday, say dem want better leadership for di state.
Oyinlola say dem decide to support Oyebamiji because dem no happy with Gofnor Ademola Adeleke’s gornment, especially over wetin dem describe as lack of inclusion.
Oyinlola, togeda with other PDP leaders, say dem no dey leave PDP or join APC, but dem believe say supporting Oyebamiji na necessary decision to move Osun forward.
Im say di group go vote massively for Oyebamiji because dem want rescue di state from wetint dem call political nepotism and bring back consultation and collective responsibility.