By: Mariam Ajayi
Arsenal legend Alan Smith don warn di club say Galatasaray striker Victor Osimhen fit no be di right tactical or financial choice for Arsenal as di Premier League champions dey consider whether to sign di Nigerian striker dis summer.
Smith tell tv tatafo pipo say Arsenal need a proper centre-forward but dem must make sure say whoever dem sign fit well into Mikel Arteta squad without disturbing di team chemistry.
Osimhen, wey dey play for Galatasaray after e leave Napoli, don dey linked with Arsenal and other top European clubs dis summer because of di goals wey e dey score.
Smith say although Osimhen fit score plenty goals, Arsenal need to carefully consider di huge money wey dem go spend on am and whether di deal go really work for di team.